Thursday, 24 May 2012

9ja Street Lingua


9ja Street Lingua


Written on Tuesday, 3 August 2010 at 06:59 •

E don reach tym wey we, as

origina 9ja pples go stop 2 dey

use abbreviations like LOL, LMAO,

LMAOROTF, BRB, WAS, etc.

When we fit dey use abbreviation

for our own exceptional street

lingua.

Behold them:

1] LWKM - laugh wan kill me.

2] LWKMD - laugh wan kill me

die.

3] MIDG - make I dey go.

4] WGYL - we go yarn later.

5] IGA - I gbadun am.

6] ICS - I can't shout.

7] DJM - don't jealous me.

8] WBDM - who born the maga.

9] UDC - u dey craze.

10] NUS - na u sabi.

11] WSU - who send u.

12] OSABZ - over sabi.

13] ITK - I too know.

14] WDH - wetin dey happen.

15] NDH - nothin dey happen.

16] FMJ - free me jo.

17] BBP - bad bele people.

18] HUD - how u dey.

19] WKP - waka pass.

20] BBG - baby girl.

21] KKL - kokolette.

22] MML - mamalette.

23] GFF - gbono fele fele (e.g.

She GFF).

24] NTT - na true talk.

25] IKU - it koncain u?

26] NDM - no dull me.

27] LGT - let's goo there.

28] IFSA - I for slap am.

29] IGDO - I go die o.

30] YB - yess boss.

31] NLT - no long thing.

32] 2GB - 2 gbaski (e.g, d song

2GB!).

33] CWJ - carry waka jorh.

34] WBYO - wetin be ur own.

35] U2DW - u 2 dey worry.

36] U2DV - u 2 dey vex.

37] MKG - maka gini.

38] WSDP - who send dem papa.

39] INS - I no send.

40] NWO - na wa oo.

41] NMA - no mind am.

42] MIHW - make I hear word.

43] NBL - no be lie.

44] NB - na beans?

45] INFS - I no fit shout.

46] WWY - who wan yarn.

47] NBST - no be small thing.

48] WD - wetin dey.

49] UNGKM - u no go kill me.

50] O2S - omo 2 sexy.

51] DDDD - dey dere dey dull.

So, no DDDD read learn and use

them


No comments:

Post a Comment